Pidgin news:Six hour curfew don carry chair sitdown as One person don lost him life ontop who go be next Imam for Paiko Area of Nigger State


As at of this time, one person don carry waka and plenty others don woudjo for body and many properties don join accestors as youths of Hausa extraction and their Gwari counterpart  engaged in war of supremacy in Paiko, Paikoro local government council of Niger state.
We been don follow hear say the Niger State government don say make six hour curfew carry him chair come sitdown for the area of minna wey dem they call Paiko based on say peace don leave the area go for wetin Oyibo peaple dey call Sabbatical. In other words crises full ground for the place remain and this curfew na from 10pm to 4am.

Still on the matta, the Chief Press Secretary to the governor Dr Ibraheem Dooba don follow say anybody at all wey no gree comply with this order go dance to the beat wey be say there Law don make put for ground.

appointment of the deputy Imam after the before-befor Imam join him accestors them for Paiko area of Minna nahim the gwari youths for the area no gree for o, wey them be come carry body dey protest befor all this gbege come happen.
For anoda gbege wey happen for Minna wey be capital for the State, properties including houses and cars wey be say the money fit plenty reach millions of Naira don destroyed after two Islamic religious sects laid claims to a mosque wey we beleived say them don built several years back at Angwan-daji area of the state capital.

hmm... my peaple, na wetin eyes see mouth go sabi how e go talk am, na how wuna see this matta wey carry body full ground like chemistry matter so for Paiko area of Nigger State?























WELCOME TO THE TEAMTAYO FAMILY BLOG... it's important to add our link( www.teamtayonews.blogspot.com ) to your browser home page for easy view of our blog post and use the SHARE LINK below at just a click to share our post with your facebook friends. As well, share your view using the comment box below, comments on Areas were the blog admins can serve the family members well are also welcomed as the TEAMTAYO family blog srive to be the best in Nigeria, Africa and the World at large...

No comments:

Post a Comment

Please be polite with your views in coment...